1. Masturbation : generally self, masturbation nah bad thing and the moment wey you start am like this, toh nah only grace of God fit help u ooo. Because the more wey u dey release sperm, the more u dey waste am. You no understand abi? Ok suppose u masturbate today, you masturbate 2moro, you do am completely for a week, instead make the sperm dey store to it gland, u just dey waste am, as such e fit cause low - sperm count.
2. Too much sex: you wey ur thing no dey stay one place, nah all the whole for this'd world u don chuck finish, ehn bros u better slow down before u get low sperm count.
3. Sugary foods: As a man self u no suppose dey take too much sugar, e dey cause damage to the body, and as such e go fit lead to low sperm count and water water sperm wey no go fit make u give girl belle
4. Stress: yes, e get plenty things wey our people dey neglect, see ehn body no be fire wood ooo, wetin dey this life self, shey nah only u?? Abi u wan die before your time??... Ok u wan get money abi?? Is that the reason why u no go give ur self correct rest... ALL WORK WITHOUT PLAY MAKE JACK A DULL BOY... Even GOD when e created all things for one week e rest on the last day.. So y u no wan rest, too much stress go cause wahala ti ur body. So make u try dey catch fun.. @ least once in a week, try make u commot with your family or friends... Even if u no get money, make u and ur wife abi ur friend dey stroll commot... And make una buy like pop corn or juice, make una dey seep am small small... Lol...
5. Too-much of alcohol : Bros J.... U try oo. Shey nah because dem dey hail u say nah u sabi take 1 crate of gulder finish.. And u never born pikin oo.. Even those wey dey hail u don born upto 3 children... U still dey find pikin abi... U better stop to dey drink alcohol if u wan born... Toh.. MOSES DON DO HIM PART OO.. E REMAIN UNA NAW:::
0 comments:
Post a Comment