Saturday, 31 October 2015

I be 31 years old, i never get any Serious Relationship: shey make i dey Worried?

I dey confused now, and i don tire self, i come here to seek counsel. i be 31 yr old and nah man i be, i dey work for bank. I get my own apartment and i get my own personal car, atleast i dey comfortable, i dey chop wetin i want. i never ever dey for any serious relationship for my life. the few ones wey i try no just dey work out.

most times the ladies no even measure up, and the few ones wey measure up just dey in a hurry to marry (maybe nah because they pass me for age sha)

my friends too dey wonder say with my present state now girls suppose dey follow me up and down. they talk say i no dey take them serious. And i no be gay and i no go ever ever be gay.

i agree say my job leaves me little room to go out because i dey work almost every day. in fact in a whole month i have just 2 free weekends. 2 days out of which i still go to work.

Abeg shey something dey wey i fit do wey go make me get correct girl and also dey for a healthy relationship. i desire to have a balance.

0 comments:

Post a Comment