Thursday, 31 December 2015

Naija tori: NTM fans make una help me out oo

image

I borrow my friend 100 thousand naira for her wedding and when we dey do agreement, she talk say she promise say she go pay back my money immediately after the wedding. And she even talk say nah me go help her pack the money since we be friends, so that i go commot my money inside after the wedding, but on that wedding day sha, she no allow me even near where the money dey , naso she call one of her sister say make she pack the money for her, and according to wetin i hear, she say she no trust me.. instead me to help her pack the money as we don agree before , the girl no allow me pack am oo.. And nah since January 2013 i don borrow her this money and she don pay me 60,000 inside 100,000 ..

Abeg naijatoomuch fans wetin ah go do now.. Make una advice me...

Related Posts:

0 comments:

Post a Comment