Saturday, 5 September 2015

Make we dey thank GOD say buhari's nah our president, Ajimobi said

De governor of oyo state wey him name nah Abiola Ajimobi dey praise president buhari for de anti- corruption war wey him don embark on since when him enter office

de governor talk am for radio say nah wetin good for nigerians be that.

He talk say "i fully support buhari". The governor con dey even thank God say nah him nigerians vote for, cause him explain say buhari's nah the best man for nigerians presently.

Ajimobi further explain say buhari na man wey dey determined to wage war again de politicians and officials wey dey chop naija money. "if we no take care of this bad habit for choa choa officials we no go fit grow our economy"

ajimobi talk say "them go appoint 10 special advisers and commissioners dis month, we don reduce our ministries to 13.

De money wey we go dey get nah to pay salaries, if we use am do another tin, e dey against law (illegal) and dem go pay about N17 billion to state government workers.

We suppose pay local gov't workers N9 billion but as at today, dem dey owe workers about N21.3 billion.

Wetin con mean say after dem use bailout fund pay workers salaries, we go still dey owe till our allocation or internal revenue increase.

According to him, de next action wey them go take nah to cut workers salaries, conserve or reconstitute.

Them no go give chance @ all, because dey ready to block all the place wey dem dey steal Nigeria money, and any civil servant wey them catch go ear the odor of him body.

People dey complain say we wicked as per the matter of traders, so we don calm down.

Now de same people don dey come our place say dem register Der embarrassment over de condition of our environment.

"we don decide say as from October 1, e no go easy for street traders cause we no go show mercy this time"

we go use Oyo Youth Empowerment Scheme (OYES) personnel take achieve that one!

We dey use this medium take inform una say Muhammadu Buhari don mark him first 100 days for office today, September 5.

0 comments:

Post a Comment