Sunday, 27 September 2015

Wetin go make you ignore your long time friend, way back from secondary school??

Wetin go make you ignore your long time friend, way back from secondary school??

You and your classmates finish school, una depart for about 5years, and e happen say you and this your classmate, una no like una self even for class, then one good day like dat you travel go another country ,you con jam this your friend wey una no like una self for school, even to talk to una self, nah yawa, and wetin this your classmate do for you wey make una no dey talk pain you die.... If you see am again for like 5years

will you talk to him or you will just pass by....

0 comments:

Post a Comment