I don tire oo..my name nah segun admin abeg help me post this.
Good day to all naijatoomuch goons wey dey house.
I don tire for my matter oo, de tori wey i wan share with una today be say, e get one girl wey i jam for club and with de way i sight this girl, she go good well if she see person wey good for handle her, and as i dey i no dey too fall for any kind yeye girl, but this girl just different, she just dey make me get sleepless night, and i no like to dey hide my feelings at all. This happened last year October to be precise, so as i tell this girl wetin dey my mind den she con first wine me for like 2 weeks, then she con finally agree sha, i dey make sure say i do everything wey i fit do just to dey make her happy everytime. Well me and the girl dey love up nicely, but something crazy happen today and i no for believe am, up on the way i love this girl, i met her with my best friend on bed, ha, God!!! My head don scatter, i don confuse so tey i no sabi wetin i go do the two of them, i no wan commit murder, but e pain me no be small.
My question be say, shey una think say this girl and my best friend don dey into this affair for long??
Another thing be say should i dump the girl or make i just continue cause she dey beg me, she said nah devil work!!
And for my best friend what should i do to him??
Am waiting please, help me naijatoomuch fans
0 comments:
Post a Comment