You see that fine girl? She die while having an abortion, her name nah Jane Timothy, she's from Akwa Ibom, After all the investigation wey i carry out for her matter, e happen say the man wey impregnated her don already talk say he go marry her, after they don date for like 2 years then the guy talk say e no dey ready to nurture any child now, due to say him no dey financially buoyant, and so?? When e dey do am e no know say him no dey financially buoyant abi?? Then after the guy frustrate the girl tire telling her that he will still marry her and so on... She then went to commit adultery, naso she die ooo... She and the baby die together.... Now the guy do as if e no know anything until when i intervene for the matter!! Currently the guy dey police station...
LESSON:
Please and please this one no be for my own benefit, but wetin i go tell you be say, we need you, you dey very very important to us... E get reason why God Bring you come this world, nah for you to help us, abeg no kill your self because of any man wey no dey ready to nurture pikin, try make you born am, e go take responsibly by force. Wait why you go even allow a man wey never Marry u sleep with you?? Why?? If e love u truly , e go wait till una marry. Abeg make our girls wise up......
0 comments:
Post a Comment