
Senior Special Adviser to President Buhari dey on The Osasu show (a current affairs program wey nah Osasu Igbinedion host am, broadcast journalist and media expert). see wetin him talk about President Buhari (by the way, the episode go dey show again this night, Monday September 14th at 7:30 PM on AIT):

"The moment wey [President Buhari] see me he say, Chief Adesina, "welcome to Sambisa house". Naso We just laugh then we start dey talk serious matter.
He tell me say, wetin I want from you for this job nah the truth. Make you always dey talk truth all the time. You know say i be general, I fit argue, but abeg make you also follow me argue. If your argument pass my own i go just accept am @ once!." Mr. Adesina talk say, "Buhari's administration no be the kind of yeye administration we you go just dey lie because you wan please am or you go dey tell am wetin he wan hear when nah lie, nah the reason why him ask me for the truth. and naso we dey relate with am. I wan dey believe say in the next 45 months wey the administration go dey end, Nigerians go dey happy say they elect President Muhammadu Buhari."

0 comments:
Post a Comment