Ghanaian Actress don Divorce her Husband just 4 Days wey dem do Wedding [See Why]
On the day wey dem do wedding , dat na about last week Sunday
Ghanaian actress wey her name nah Rose Mensah, which everybody know her as Kyeiwaa, don divorce her husband Daniel Osei, if no even sure wheda e reach four days wey dem marry sev. De Kumasi-based guy wey dey sell Spare Parts and him nah dealer wey tie the knot of marriage with the popular Kumawood actress about last weekend for Kumasi.
Twenty-four hours after them wedding, e come shele say the man wey she marry don get wife for house with kids sev...
And even now sev the Wife of Mr. Osei don also ear about the marriage but the husband tell her say the marriage between him and kyeiwaa nah just movie dey happen between them and nothing more. E also happen say Mr osei just go rent people as in the guy just go rent crowd for the weeding ceremony.
Kyeiwaa, don also talk to Kasapa FM say she don quit with Osei, and she no go ever ever go back to am again.
Chai this tori ehm?? I just dey confused cause i no sabi who dey at fault here.. Abeg una go fit tell me for comment wetin make the man do wetin him do!??
0 comments:
Post a Comment