Saturday, 26 December 2015

Friday, 25 December 2015

Thursday, 24 December 2015

Yes! Merry Christmas to Una oooooo.... Send my meat o!!

image

wetin we go say? Than to thank God, E NO easy nah, to see January, enter February come reach December, and God come keep you sowtey, you see Christmas, e no easy, my prayer to Una be say, HEAVY BLESSING, GOOD CONTRACTS GO BEGIN DEY LOOK FOR YOU IN JESUS NAME, LONG LIFE AND PROSPERITY COUPLED WITH PEACE GO ENTER YOUR LIFE, MY GREAT BROTHERS AND SISTERS, GOD GO GRANT YOUR VARIOUS AND DIFFERENT HEART DESIRE IN JESUS NAME! AMEN

MERRY CHRISTMAS TO YOU ALL,
ENJOY YOUR SELF,
STAY BLESSED,
THANK GOD,

AND ABEG NO FORGET TO INVITE YOUR FRIENDS HERE. God bless una!

See the way my Boyfriend they beat me always!!(abeg make una read my story)

Nawaoo...

See the pictures of wetin Mrs Melissa send me for Facebook..

She talk say:

image

Abeg make una see wetin dat guy do my daughter, the bastard Verbally and physically abuse my daughter, and wetin pain me pass be say she dey fear to tell me since all this days, abeg which kind fear?? She dey claim say she still love am so she no fit tell me!!

The guy name nah WAYNE COWINGS AKA CASUILE KING , her dey live for my daughter house and e dey do unspeakable things... Something wey person no suppose do, and her don leave with her for 5 months now.

Abeg make una help me advice my daughter, cause nah London we dey.. And nothing wey i tell her, she no go gree hear me out.. Am so angry now but i just dey take things easy with her.

See my daughter face image

Please help me share this post with your Facebook or twitter friends


lets stop domestic abuse today!!

Saturday, 19 December 2015

Wetin you go do if you come back from work and your wife dey do this thing to your baby? (Photo)

image

As we know say... Everything get him own time... I no say make she no chat oo but no be this kind time nah... Even tho when we know say women like to care for their children pass man... But this woman case different oo .. Instead make she breast feed the pikin.. She con put the milk inside feeding bottle.. Choi...

If you catch your wife like this.. Nah wetin u go do...??

Photos: senate president Bukola don clock 53 years today (see how e dey celebrate am).

image

Our Senate President wey him name nah Bukola Saraki don enter another stage of him life.. E no add 1 number to him years today. The Senator wey enter 53 today dey encourage people wey dey Ilorin say make them join am celebrate him birthday by reading the Quran and giving thanks to Allah. See wetin him write below :

image

image

image

image

image

Friday, 18 December 2015

How many men fit do like this.... Lolx.. Must see oo...

image

lolx... Because ur wife nah ... Banker so u go back pikin, wash plate.. Wash cloth probably... Lolx.. This is nice...

If you fit do am for your wife... Make i see ur comment.. And if u no fit.. Make i see ur comment.. And give reasons why you no fit...

And for the ladies ..you fit allow your husband do this things for you?? Give your reasons too ooo...

armed robbers attack bank For Osun state and they kill 2 people

image

Two people die after a gang of armed robbers attack a new generation bank wey dey for Ibokun in the Obokun Local Government Area of Osun State on Tuesday December 15th.

The people wey dey the Area talk say the armed robbers attack the bank at about 6pm when the bank don close.

They first go straight to the ATM, they commot all the money wey dey there.. Then they con move to the entrance door and the blow the door of the bank, they steal some money wey dey the banking hall. They kill the bank security guard and they kill one other man wey dey live for the area.


Nah my own words be this oo... E no dey part of the new...

Ok.. The way i see this news ehn.. I sure say na young, young boys go dey involve for this kind attack... But wetin dey cause all this thing self.... Shey nah LACK OF EMPLOYMENT?? OR Na JUST BECAUSE GUYS NEED MONEY TO SHAYE (to Enjoy Life) ????

New Naija Tori: my Cousin don get belle for me... Shey make i marry her??

image

Abeg Nah only matured people we need for this place oo...

Dear Naijatoomuch please help me post this!

My name Nah Abiola, i get one girl like that wey we dey date for secondary school.. But as we wan commot, abi make i say.. As we wan graduate.. Me and Biodun wey be my girlfriend for school, we love our self die... So after graduation we depart, i move go lagos and Biodun go Port Harcourt.. Well as time goes on sha..we con meet again.. For lagos here.. And we started dating .. And we wan even marry for March 2016... But the problem now be say.. Me and one of my cousin sister dey get things together.. And now she don get belle for me... I no know wetin to do next now... Honestly if she tell her parents say nah me give her belle.. Wahala go burst ooo..please make una advice me abeg.. I dey fear now oo...

Thursday, 17 December 2015

YouTube star wey him age nah 15, arrested for sexually exploiting a 12year old girl

image

YouTube star StevenFernandez, 15, was arrested on Wednesday for allegedly exploiting a 12-year-old female for sexual acts.
According to TMZ, the 15-year-old skateboard star and social media guru allegedly promised to introduce the young girl to celebrities in exchange for sex acts. The young girl agreed and an sexual act was committed.
Police said Fernandez was the 'prime mover' in the conspiracy to lure young girls off the street.
LAPD also arrested his manager JoseBarajas, 22 and another skater, 27-year-old KeelanDadd for helping with the exploitation.
They were all booked on charges of committing lewd and lascivious acts with a child under 14 - a felony punishable by up to eight years in prison.

image

image

Barajas’ bail was set at $475,000 and Dadd’s at $200,000. Both men have bailed out.
Fernandez, as a minor, was released to his mother and ordered to wear an ankle tracker, pending his court appearance.

See the kind tattoo wey cover Miley Cyrus' brother's body

image

Nawa oo... Shey na another swag be this or nah madness him dey exhibit... I tire for this oyinbo people ooo... NAh Miley Cyrus' 26-year-old brother post this selfie for Instagram on Thursday wey they show all him chest and almost all him entire body wey tattoo-cover all him body.

Wednesday, 16 December 2015

Wetin you go do if this thing happen to you... (tori of a wedding without food)

Another Tori Don Land so ooo....

Honestly i go one wedding like that and you fit believe say food no dey?? What the .... ???? Ok see wetin happen...

The bride and the groom don already make arrangements of how their wedding go be .. They don pay all the bills wey dem suppose pay for the people wey go sing, decorate, cook food ..... E.t.c

ok ..on the wedding day the husband call the woman wey suppose cook for them.. Say people dey wait for reception nah... Dem dey hungry , no food...

And the woman was like... "NAH TODAY BE UNA WEDDING"?? Jesus !!!

The husband just annoyingly off the phone... Naso them address everybody ooo.. Say na wetin happen be that...

But the question now be say...

As the wife Or As the Husband... Wetin u go do to the woman... After making payment.. After telling her the date of una wedding.. And she dey talk rubbish for phone....??

Wetin you go do her...

As for me... Ehn .. I just pray say e no go happen to me oo.. Cause i go Break Break her... Lolx...

Saturday, 12 December 2015

Yinka Ayefele talk say nah yesterday mark 18 years anniversary of him accident wey cut him legs

image

The great musician wey dey sing gospel music shared this photos from the accident scene wey happen.. Since 18 years ago, as he dey thank God say he no follow the accident waka....God spared his life. More pics after the cut...

image

image

image
Before the accident...

Tuesday, 8 December 2015

LIST OF SOME THINGS WEY NIGERIANS DEY SEARCH FOR GOOGLE

image

I LOVE NAIJA DIE... I DEY VERY PROUD SAY AH BE NIGERIAN... SEE WETIN WE CARRY COME TODAY...
.

LIST OF SOME THINGS WEY NIGERIANS DEY
SEARCH FOR GOOGLE
.
1) My pastor says I have a spiritual
husband, please how do I divorce
him ? .(lol.. Shey Google don turn to T.B Joshua??)

.
2) How do I increase my manhood
size? (lol... Go use increaser na.. I tire oo)
.
3) How do I browse for free? (goto simplecoded.com nah... Lol)

.

4) How do I borrow credit without
paying? (see thief... Just enter www.simplecoded.com jawe)
.
5) I want to make money without
working, how? (lol... Go Rub bank nah..)

. 6) How do I know a virgin? (lolx.. This one funny die.. No worry i go create virgin detector)

.
.

7) How can I make call without
recharge card?(enter simplecoded.com)
.
8. How can I sell my kidney? (chai.. Bros.. Cool down nah.. Ah.. Money fit make some people no get sense oo)
.
.
9) My Husband is cheating on me,
what do I do? (calm down dear... Naijatoomuch.com go supply u the tips wey you need)
.
10 how do I increase my buttocks? (yeye girl ..go give forganizer nah)

.
.
11) My wife is having dreams of me
cheating.. Am scared please, What
do I do? (chai baba... Enter naijatoomuch.com)
.

.
12) Why do men cheat? (cause dey need a better alternative nah)
.
.
13) How do I increase my breasts
size? (give forganizer nah.. Nah just #20)
.

.
14) How do I hack a facebook
account?(calm down.. If nah ur acct i hack u go like am??)
.
15) My husband is impotent and I
need a baby..what do I do? (see doctor... Google no be doctor.. U hear me??)
.
16. Latest News on Biafra? (e dey Naijatoomuch.com)
.
17. When would Buhari visit Nigeria? . (Lolx.. Next 300 century..idiot!!)

.
.
18. How do I make Buharis daughter
zahra marry me? (hahahahahhaha ... some people no get sense oo... Chai.. My brother go work)
.

.
19. Why do women cheat on good
men? (see simple question wey u still dey ask oo... Chai.. Because dey need bad men nah!!)

.
20. How can I find a sugar mummy? (enter keke napep... E get some fat fat madam wey dey Der... Lolx... I no fit laugh jawe)
.
.
21. How can I make a girl fall in love
with me without spending? (chai.. Wetin i go tell this one naw... Eeehm... Just find person wey love u jawe...)

.
. 22. How do I steal Linda Ikeji's blog? (lolx.. See this one oo... Nah person work u wan hack?? Mumu...)

See How We dey Bath for cold season (Harmattan bathing)

See How We dey Bath for cold season (Harmattan baffing)

image

come make we talk true oo... You know say na cold season we dey so.. And e get one kind friction wey dey catch person if you wan pour water for body... You go even see some people wey dem go enter bath room ... 1 minute dey don commot.. Lol... Wetin dey do?? Na to just pour water for leg ..hand and face... Abi u no do am?? No lie oo.... Nowadays self nah students dey do am pass... Those fine fine girls self dey do am... Tho e dey sweet sha.. But me i no do am oo... Lolx... Hot water wey boil from 6a.m. To 7a.m na him i dey use baff... God punish devil.... Lol..

Oya make we compare them.. Which photo fine pass inside wizkid and tekno

Oya make we compare them.. Which photo fine pass inside wizkid and tekno

forget say wizkid get mouth pass tekno... Atleast tekno too don get small mouth... Lol...

Which of these photos make brain??

image na tekno be this



image
oga wizkid

Tuesday, 1 December 2015

Mercy Aigbe and one of her fans.. Dey fight seriously for instagram because of her daughter see (Screenshots)

image

Oboy... I dey love this kind thing die... Omg abeg make this kind thing dey happen every day so that ah go fit dey share am with my lovely fans.... Lol... I like gossip die...

Yesterday actress Mercy Aigbe put upload one picture of her self and her 14 year old daughter Michelle for instagram. She captioned the photo say, “Whose selfie is the best? Mother or Daughter?”, as u know nah say new things rocks more that old thing... Make mercy aigbe go sempe... Lol ... people went for her daughter, of course but e get One of her follower like that wey no green oo.. E just cause Gobe.

The follower, wey him name nah diamondbee12 comment for the photo say "he bet the teenager is also having sex at her tender age and next time Mercy should compare the number of sexual partners they have had". Naso the thing start like play like play oo... Things boiled up after that comment and an Instagram fight that lasted hours ensured between Mercy Aigbe and the fan
see wetin shele below...
image
image

image

image

image

image